Di start of new waka

 Na here we want take start new waka way oyimbo people call "journey" ontop intanet. Di waka name na "Tori Way Sure" dis waka na coret one way sure, way every pesin sopos join bodi de waka with us. This waka go put smile for pipu face, e go put food ontop dia table, e go hellep sov plenti wahala, e go cary work give pesin way no get work, e go make pesin way be nobodi become sombodi and e go fit pay some pipu sef join. 

Pesin fit come de ask say watin be Tori Way Sure. 

Dis na tori way dem nack for pigin way be countryman language. Our tori dem de simple, e no long, u no go read tire come kpeme for sleep, na tori way fit help u len, tori we u fit nak head for wall say na truth. 

Our tori dem na watin cocern life matter, watin fit help countryman for business, news way heavy ontop we country and abroad, futbal tori, maket wahala, skull and food mata. 

We de promis u say if u de follow us, u no go eva lak. So make u de use our tori de relax and enjoy urself. De share our tori for ontop social media like Facebook, whatsapp, Instagram, tiktok and different-different place way u sabi. 

We de say very big tank u as u make up ur mind say u go follow us for dis waka. U do well oo! 


Comments

Popular posts from this blog

Watin u gas to know about how woman suppose propose to man

3 tins way u suppose to de do everyday

How u fit plan and marry for just 1 and half year